Crazie fone conversation....
 Elohor:  Hello Stanley,na me Elohor oh.
Stanley:  Hey my crafty, how far naw?
Elohor:   Shuo,your voice come shange oh..abeg i nor geh credit i jus wan ans you one question...no be me with you be age dat time? you tell your junior broda ovie say he senior me?
Stanley:  Wish  kain question you kon dey ans me dis kain early morning?
Elohor:   Shuo,no b small thing oh..i go una ass yesterday.Ovie jus insult me finish.i no even know say he don come back from Lagos sef.
Stanley:   Ovie? Ovie don come back since nah..
Elohor:   Infact eh,as i talk to you so eh my belle jus dey turn me..if na anoda person tell me dis kain word i know wetin i for do am oh.
Stanley:   Abeg tell me quick police jus call me say dem go release my guy today..we wan go carry am from creche..Wetin he tell you?
Elohor:    Make Ovie tell me say,"how have you been"...na me Ovie dey speak English for..i don suffer..How many days he take stay Lagos?
Stanley: Mscheeww..your own na small thing oh..he look me sotey he tell me say,"Stanley,i think you really need to start brushing your teeth daily".the kain slap wen i give am eh.. i nor even let am talk finish..he dey crazy..him father!..
LOL...mad folks out there! 
 
This comment has been removed by the author.
ReplyDeleteNice one... Hilarious!!
ReplyDelete