Wednesday 6 June 2012

Stupid Kelvin



My name na Cosmos and I be warri boy...I manage finish from Delsu 5yrs ago and na since den I don dey fine wrk oh..nor to small thing.E nor get d kain  dirty work wen I never reason to do oh...Una know say as I go school reach I push wheelbarrow for warri?..shuo,nothing I never do oh.sometimes sef I go wan follow all these yeye boys do 'night shift' bot dem no dey gree make I follow dem..oh boy,d thing na D.I.E .
Nor be even all dis ones dey vex me for the matter sef..Na my small brother Kelvin dey provoke me.Since wen dem born Kelvin,he never ever respect me..but as I don dey tey for ass (house),he don dey call me brother Cosmos!...the first day wen I hear brother Cosmos for him mouth,convulsion nearly kee me.before I know,he don dey call me bros Cosmos.
Small time,he start to call me bros Cos..Jus las week for here,dis stupid Kelvin start to call me brocos!..who nor know wetin brocos be,make he go sheck warri dictionary..d thing jus dey pain me since becos if to say i don geh work dis stupid boy no go dey call me name wen no b my own...
God u dey see us oh...help ur boy quick oh before Kelvin go start to call me agada becos d way wen he dey look me these days,I nor understand.

No comments:

Post a Comment